Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, James Gallagher and Philippa Roxby
- Role, Health and science correspondent
- Twitter,
-
US researchers tok say make dem dey give Mosquitoes malaria drugs to clear dia infection so dem no go fit spread di disease.
Malaria parasites, fit kill nearly 600,000 pipo yearly, mostly children, na female mosquitoes dey spread am wen dem suck blood.
Current effort aim to kill mosquitoes wit insecticide rather dan curing dem of malaria.
But one team for Harvard University don find pair of drugs wey fit successfully comot malaria from di insects body wen dem absorb am through dia legs. Coating bed nets in di drug cocktail na di long-term aim.
Sleeping under bed na one of di most successful ways of…